Monday, September 05, 2005

So who kill am if no be you ?

No be me Kill Jesus!
I don hear many people self righteously utter
To me, that kind of talk belong for Gutter
Jesus die for you now
How you dey forget things , na wa
So who kill am , if no be your sin im die for ?
Pilate no fit wash im hand when im try before!
Because of im death, we get hope
No more waiting for the pope
To declare us as saints
for that na mere paint
Wey cover dead men's bones
wey don cross over to hellish zones
Abeg na you and me Kill this innocent man
Na love motivate this salvation plan
Im death na our Gain
Only Satan na im e still they Pain
Satan , e pe le o
I am no more your Bole(roasted plantain) o!

0 Comments:

Post a Comment

<< Home

designed by finalsense.com